29 Na dem dey keep di holy tins, flour, wine, olive oil, incense and spices.
Na dem still dey kare for di bread wey dey der; di ofrin flour; di bread wey nor get yist; to dey mix dem and all di tins wey dem dey measure.
Some of dem dey keep di tins wey dem take dey woship God for di temple. Na dem dey bring and keep dem anytime wey dem use di tins finish.
Dem do evritin wey di king orda koncerning di priest, Levi pipol and di propaty dem.
“Make yu go kommand Israel pipol make dem give yu pure oil wey dem press komot from olive plant kon pour am for di lamp, so dat di lamps go always dey give lite.