E still get Shemaya pikin, Obadaya and na Galal wey Jedutun born, bi en grand-papa. Berakaya wey Asa born, na-im bi Jedutun papa. Na Elkanah bi Asa papa and na Netofat pipol land dem dey stay.
Wi still get Matanaya wey Mikah born, wey Zabdi, Asaf pikin born and na-im dey lead di tanksgivin and prayer. E still get Bakbukaya wey dey support Matanaya and Abda wey Shammua born, wey Galal born, wey Jedutun born.
Di main Levi pipol oga for Jerusalem na Uzzi wey Bani born, wey Hashabaya born, wey Matanaya born, wey Mikah wey bi Asaf grand-pikin born and na en family dey sing for God Temple.