Evry gift wey King David, di leaders, doz wey dey lead tazon and hundred sojas dedikate give God, na Shelomit and en relashon dey guide dem for di temple.
Dis na di family leaders for Levi tribe: Hashabaya, Sherebaya, Jeshua, Binnui, Kadmiel and di oda men wey dey stand face dem wen dem dey do di praiz and tanksgivin service and just as David wey dey serve God kommand dem, one group dey praiz with di oda group.