Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 9:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Dem bi 1,760 priest wey kom back and dem bi leader for dia family. Dis men dey work well-well and na dem dey do God work for di temple.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 9:13
6 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As for Hebron family: Hashabaya and en relashon wey bi 1,700 men wey pipol dey respet, na dem dey work for di west side for Jordan River for Israel. Dem do God work and wetin di king wont.


King David choose 2,700 men from Jeriaya relashon wey pipol dey respet well-well kon sey make dem dey lead Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe. Na dem dey judge any matter wey koncern God and di king.


Obed-Edom first pikin Shemaya still born sons wey bi leaders and pipol dey respet dem well-well.


E still get Adaya wey Pashhur pikin Jeroham born and na Malkijah bi Pashhur papa. Adiel pikin, Priest Massai still dey and na Jahzerah bi en grand-papa. Na Meshullam born Jahzerah and na Meshillemit wey Imma born, bi Meshullam papa.


Levi pipol wey kom back to Jerusalem na: Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born wey kom from Merari tribe;


and 128 of en strong men follow am. Di pesin wey dey lead dem na Zabdiel wey Haggedolim born.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ