King Nebukadnezzar karry evribody komot from Jerusalem, plus di ofisas and sojas (all di pipol, na 10,000). Plus all di men wey get skill and doz wey dey work with iron. E nor leave anybody esept di poor pipol wey dey di land.
Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas.
Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.
God put am for my heart sey make I koll all di pipol, dia leaders and ofisas togeda kon shek dia family rekord. I si di first set wey kom back from Babilon and dis na dia rekord:
God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.