Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 8:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 8:28
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and Miklot wey bi Shimea papa. All dis family stay for Jerusalem near dia oda family pipol.


Some of di pipol wey kom back to Jerusalem na from Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes.


Doz wey dem rite dia name down, dey head families for Levi tribe and dem dey stay for Jerusalem.


Doz wey kom back from Benjamin tribe na: Sallu wey Meshullam born. Meshullam na Hodevah pikin and na Hassenuah bi Hodevah papa.


Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.


Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.


Zela, Haelef, Jebus pipol town (wey bi Jerusalem), Gibeah and Kiriat. Dem bi fourteen big and small town. All dis na di land wey Joshua give Benjamin tribe.


Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ