22 Efraim wey bi dia papa kry for dem well-well and en brodas kon dey sorry for am.
Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well.
All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.
Zabad Shutela. (Afta Shutela, Efraim still born Ezer and Elead wey dem kill wen dem go tif animal for Gat pipol land.)
E sleep with en wife again and e kon born and dem koll di pikin Beraya, bikos di family don face trobol well-well.
Job three friends hear wetin dey happen to am, so dem kon sey dem go-go greet am. Dia names na Elifaz from Teman, Bildad from Shuh and Zofar from Naamah.
and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.)