Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.
God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.
As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.
anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.