Dia work na to help Aaron shidren-shidren as dem dey serve for God Temple. Na dem dey kare for di kourtyard; di rooms; to dey klean di holy tins and any oda tin wey koncern God Temple.
Dem give Gershon family for Levi tribe dis towns: from half of Manasseh tribe, dem give dem Golan for Bashan (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) with Beeshtarah, all di aria for der and dem bi two big towns.