So Levi pipol appoint: Heman wey Joel born and Asaf wey bi Berekaya pikin, bikos dem bi dia relashon. Di next pesin na Kushaya pikin, Etan wey kom from Merari family.
King David and di ofisas pick some of Asaf, Heman and Jedutun shidren to profesai as dem dey play instrument and cymbals. Dis na di men wey dem choose:
Na dia papa dey lead dem and dem dey sing for God Temple, dey play cymbal and oda instrument as dem dey serve for der. But na di king dey supavise Asaf, Jedutun and Heman.