Some family for Levi; dia work na to dey play music for di temple. Doz wey dey head dis family dey stay di rooms for di temple and dat na only wetin dem dey do, bikos dem fit koll dem to play, both for day and nite.
Doz wey dey play music with Asaf shidren-shidren face dia own pot, just as King David tok thru Profet Asaf, Heman and Jedutun. Di guards nor komot from dia pozishon, bikos Levi pipol prepare sometin for dem too.
Den di man take mi enter di room for inside. E get two rooms for inside di kourt, one face sout near di nort gate and di oda one face nort near di sout gate.