So Levi pipol appoint: Heman wey Joel born and Asaf wey bi Berekaya pikin, bikos dem bi dia relashon. Di next pesin na Kushaya pikin, Etan wey kom from Merari family.
Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal.