Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.
For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
So, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin with Joshua, Jehozadak pikin wey bi di High Priest and evribody wey kom back from Babilon kon obey Oga God message wey E tell dem thru Profet Haggai and dem kon dey follow and obey God word, well-well.
So Oga God kon help Zerubabel wey bi govnor for Judah; Joshua wey bi di High Priest and all di pipol wey kom back from Babilon, so dat dem go fit do di work. All of dem kon start to build Oga God temple. Dem start di work