Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 5:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 5:26
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God kon dey vex for Israel pipol again and E make David bring trobol kom meet dem. God tell am, “Make yu go kount Israel and Judah pipol.”


Assyria king, Pul kon attack di land and Menahem kon gi-am 1,000 silva, so dat di king go support and help am kontrol di kingdom.


Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.


King Ahaz send message go give King Tiglat-Pileser for Assyria sey, “I bi yor savant and I trust yu well-well. Abeg, make yu kom save mi from Siria and Israel king, bikos dem dey attack mi.”


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Assyria king kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) for Medes town.


Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem?


Dem kill many enemies, bikos God fight for dem. So dem kon dey stay dat aria until dem karry dem go Babilon as slaves.


Beerah wey bi leader for Reuben tribe wey Tilgat-Pilneser, Assyria king karry go anoda land.


Dem rite Israel pipol name akordin to dia family for Israel kings history book. Dem karry Judah pipol go sofa for Babilon, bikos of dia sins.


King Tilgat-Pilneser for Assyria kom, but instead make e support, e kon give dem more trobol.


Di messenja give evribody for Israel and Judah, di king and di ofisas leta. Wetin di king rite for di leta na, “My pipol Israel, make una turn back kom meet Abraham, Isaak and Israel God, so dat E go kom meet una wey E save from Assyria kings.


So God kon allow di oga for Assyria sojas attack Judah. Dem seize Manasseh, hook en nose, tie am with bronze shains kon karry am go Babilon.


Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.


Na my papa dem distroy Gozan, Haran and Rezef town and dem kill Eden pipol for Telassar and no god fit save dem.


“Oga God, all of us know sey, Assyria king don distroy plenty nashons kon skata dia lands;


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ