23 Di pipol wey dey half of Manasseh tribe kon stay from Bashan go rish Baal-Hermon, Senir and Mount Hermon and dem kon dey many well-well.
Di leaders for dia family na: Efer, Ishi, Eliel, Azriel, Jeremaya, Hodevah and Jahdiel. All of dem na strong sojas wey pipol know well-well for di land.
E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill. True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.
My wife to bi, make yu follow mi from Lebanon. Make yu kom down from Mount Amanah, from Senir and Hermon and where lion and leopard dey stay.
Dem use wood from Mount Hermon take build di ship kon use cedar from Lebanon take do en pole.
Josef shidren akordin to dia family na: Manasseh and Efraim.
Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”
Dia aria na Gilead, Geshur and Maakat, plus evriwhere for Mount Hermon and Bashan go rish Salekah.