Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.
Di men wey dem rite dia names before, kom for di time wey Hezekaya bi king for Judah and dem attack and kill Ham and all Meun pipol wey dem si for der, bikos dem si grass wey dia animals go chop.
So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.
Na only human being pawa dem get, but di Oga wey bi awa God dey with us and E go help us fight all awa war.” So, wetin King Hezekaya tok kon make di sojas get strong heart.