21 Dem katch 50,000 kamel; 250,000 sheep; 2,000 donkey and 100,000 men as prisonas from dia enemies.
Dem ask and pray to God make E help dem and God ansa dia prayers kon make dem win di war.
Dem kill many enemies, bikos God fight for dem. So dem kon dey stay dat aria until dem karry dem go Babilon as slaves.
God kon help Asa and Judah pipol and dem kill Kush sojas, while di remainin ones kon run.
Dem still attack doz wey dey keep animals for di towns kon karry many sheep and kamel go back to Jerusalem.
Make una seize dia tent, animals, curtain and evritin wey dey der. Make una take dia kamels, den tell di pipol sey, ‘Na fear go kill una!’
plus 32,000 wimen wey neva sleep with man at-all.
Cinnamon, spices, incense, pomade wey dey send well, frankincense, wine, olive oil, flower wey dem take dey make bread, melu, sheep, shariot, slaves and human being soul.