For di Fifteent year wen Joash pikin, King Amazaya dey rule Judah, Joash pikin, Jeroboam kon bi king for Israel and e rule from Samaria for forty-one years.
Di remainin tins wey Jeroboam do, plus all wetin e get and en viktory wey make Israel take-ova Damaskus and Hamat, dem rite all for Israel kings history book.
God kon make di king sick. Di king get diziz for en skin until di day wey e die. Only en kon dey stay for one house, while en pikin Jotam dey kare, handle di palis and rule di pipol.