15 Kaleb wey Jefunneh born, en sons na: Iru, Elah and Naam. Na Elah bi Kenaz papa.
Na Meonotai bi Ofrah papa and na Seraya born Joab. Na dis Joab born doz pipol wey dey stay and karve wood for Ge-Harashim.
Jehallelel sons na: Zif, Zifah, Tiria and Asarel.
Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”
from Judah tribe, e send Kaleb wey Jefunneh born;
But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der.
I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua.