Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Di third one na Absalom, en mama name na Maaka and na Talmai wey bi Geshur king, born am; di next one na Adonijah and na Haggit bi en mama;

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 3:2
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King David pikin Absalom get one fine sista wey en name na Tamar. David get anoda pikin wey bi Amnon wey love Tamar well-well.


Afta Absalom run, e stay Geshur for three years.


Den e go Geshur go bring Absalom kom Jerusalem.


Absalom ansa, “Bikos yu nor gri kom wen I sey make yu kom. I wont make yu go meet di king kon ask am: ‘Wetin make mi komot from Geshur kom stay here? E for betta for mi pass dis place wey I dey so.’ ” Absalom still sey, “I wont make yu arrange for mi make I si di king and if I dey guilty, make dem kill mi.”


Wen I dey Geshur for Siria, I promise God sey, if E bring mi kom back to Jerusalem, I go-go Hebron go woship am.”


Joab ansa, “I nor go waste time with yu again.” So e take three spear kon shuk Absalom for chest, even as e dey struggol for di tree wey e hang put.


Wen Absalom dey alive, e build one big house for di King Valley for ensef. Since e nor born boy pikin wey go ansa en name, e kon give di house en own name and till today, dem dey koll di house, “Absalom Monument.”


Di king nor kon happy again. So e go di room wey dey di gate side kon bigin kry. As e dey go, e dey kry sey, “O-o! My pikin Absalom! Absalom my pikin, e for betta sey na mi die, instead of yu!”


Kileab wey en mama na Abigail wey bi Nabal wife before and e kom from Karmel; Absalom wey en mama name na Maaka, wey bi King Talmai girl pikin for Geshur;


Adonijah, wey en mama name na Haggit; Shefataya wey en mama name na Abital;


For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am.


(David neva even ask or korrect am wons sey, “Wetin make yu dey bihave like dis?” Adonijah na very fine man too and naim dem born follow Absalom.)


Di king ask, “Why yu sey make I give Abishag to am? Yu for still ask sey make I gi-am di throne too, since e bi my senior broda and Abiatar di priest and Joab dey en side!”


But Geshur and Aram win Jair, Kenat and sixty towns for der. All dis shidren na Makir wey bi Gilead papa grand-grand shidren.


Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron: Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel: di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.


Shefataya na di fift one and en mama name na Abital; Itream wey en mama name na Eglah, na-im bi di sixt one.


But Israel pipol nor distroy Geshur and Maakat; So Geshur and Maaka pipol dey stay with dem till today.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ