Dia leaders na Zerubabel, Jeshua, Nehemaya, Seraya, Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah. Dis na di list and di nomba of pipol from each family for Israel wey kom back from Babilon:
and Jeshua wey Jehozadak born, en fellow priests, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin and en family membas kon build di Oga wey bi Israel God altar back, so dat dem go fit dey burn sakrifice for der akordin to wetin dem rite for God savant, Moses Law.
For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
But naw, Oga God sey: Zerubabel make yor heart strong, Joshua, Jehozadak pikin wey bi High Priest, make yu don fear too. All di pipol wey dey di land, make una mind strong. Make una bigin work, bikos I dey with una.