I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
Nobody force Israel pipol as dem dey give dia ofrin to God. Evry man and woman bring as en heart move am to bring, so dat dem go take am do all di work wey God kommand dem thru Moses.
I bi witness sey dem dey give akordin to wetin dem get. Sometaim, dem dey give pass wetin dem get. Nobody dey force dem to do like dat, but dem dey do am from dia own mind
My brodas, sistas and friends wey I love, I dey hongry to si una, bikos una dey make mi proud. My friends wey I love, make una stand well inside Christ!
I dey happy well-well inside Christ, bikos una don finally show sey, una dey tink about how I dey manage. (I know sey una get mi for mind before, but una nor get shance to do anytin for mi).