Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 29:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 So dem chop and drink as dem dey happy for God present. Den dem kon dey shaut, “Na Solomon bi king.” Den, dem anoint am with God name as dia ruler kon make Zadok dia priest.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 29:22
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Batsheba bow kon sey, “Make my oga, di king live forever!”


e tell dem, “Make una take my ofisas follow body; make Solomon my pikin ride my horse, den una escort am go Gihon wotaside,


Di king make Benaya di sojas oga for Joab place, den e put Zadok as priest for Abiatar place.


Even dia neighbours; doz for nort wey dey far like: Issakar, Zebulun and Naftali tribe, still bring donkey, kamel and melu kon load dem with food, flour, fig, raisin, wine and olive oil. Dem still bring sheep, so dat di men go chop and Israel pipol kon dey happy more-more.


Wen David don old well-well, e kon make en pikin Solomon, king for Israel.


For di twenty-third day for di sevent mont, Solomon kon tell all di pipol make dem dey go dia house. Dem happy well-well as dem dey go, bikos of di good tins wey God don do for David, Solomon and Israel pipol.


So all di pipol go dia house dey happy, dey chop and drink and share wetin dem get with one anoda, bikos dem undastand wetin dem read give dem.


Den Jetro sakrifice and burn ofrin for God. So Aaron and all di eldas for Israel join Moses wife papa chop di food for God present.


But God nor distroy Israel leaders even doh dem si am kon chop and drink for en present.


So I kon sey, nor-tin dey good dan for pesin to chop, drink and enjoy di work wey e dey do, bikos all dis enjoyment kom from God.


So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.


So, make wi kontinue to chop with joy and drink with happiness for awa heart, bikos God don already asept awa work.


Di prince go kom inside wen di pipol don kom and e go komot wen di pipol don go.


For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ