God promise David my papa, ‘Yor pikin wey I go make king afta yu, go build temple for mi.’ And I don choose to build di temple where dem go for woship di Oga wey bi my God.
And naw, God don keep en promise. I don bi king for Israel afta my papa and I don build di temple where dem go for dey woship di Oga wey bi Israel pipol God.
But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.