And naw, God don keep en promise. I don bi king for Israel afta my papa and I don build di temple where dem go for dey woship di Oga wey bi Israel pipol God.
King David tell all di pipol, “Na Solomon my pikin God choose, but e still dey yong and e neva sabi many tins. Di work wey dem won do dey hard, bikos dis nor bi palis for man, but na temple for di Oga awa God.
Make wi praiz di Oga wey bi yor God, bikos E like yu kon give yu dis en great kingdom. God love Israel and en pipol and E wont make dis kingdom last forever. E don make yu king ova dem, so dat yu go rule well and dey good with am.”