7 For di fourt mont: Asahel wey bi Joab broda, na-im dey lead dis group. (En pikin, Zebadaya kon take-ova from am) and dem bi 24,000 men.
Joab wey en mama name na Zeruaya and David ofisas kon meet demsef for di pool for Gibeon. All of dem sidan; one set dey for one side for di pool and di oda set dey for di oda side.
Odas for “Di Thirty” na Asahel wey bi Joab broda; Elhanan wey bi Dodo pikin, wey kom from Betlehem;
Di oda sojas wey do well na: Asahel wey bi Joab broda; Elhanan wey bi Dodo pikin wey kom from Betlehem;
Na Benaya bi di leader for di “Thirty.” Na en pikin, Amizabad bi en main offisa.
Di fift mont na: Shamhut wey kom from Izhar family na-im dey lead am and dem bi 24,000 men.