34 Jehoiada wey Abiatar born give Benaya, na-im kon take-ova from Ahitofel. Na Joab bi di whole sojas oga.
Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim bi David bodyguard oga. David sons na priests too.
E follow Joab wey Zeruaya bi en mama and Abiatar wey bi di priest plan and dem kon gri to support am.
David sey, “Di first man wey go attack Jebus pipol, na-im go bi di sojas oga!” So Joab wey en mama na Zeruaya, first attack and kill dem, so e kon bi di sojas oga.
Abishai wey bi Joab broda, naim bi di sojas oga and na Jehoshafat wey Ahilud born, dey keep rekord.
Di third mont na: Benaya wey bi Priest Jehoiada pikin, dey lead dem and dem bi 24,000 men.