20 Hoshea wey Azazaya born, na-im dey lead Efraim tribe, while Joel wey bi Pedaaya pikin, dey lead West Manasseh.
Na Obadaya pikin Ishmaya dey lead Zebulun tribe, while Jerimot wey Azriel born dey lead Naftali tribe.
Iddo wey bi Zekaraya pikin dey lead East Manasseh for Gilead; Jaasiel wey Abner born dey lead Benjamin tribe,