Dis na David sojas wey get pawa well-well: Di first one na Josheb-Basshebet wey kom from Tahkemon and naim bi di leader for, “Di Three”, e fight with eight hundred men and e kill dem for one war.
Dis na di list of leaders for Israel family and tribe with ofisas wey dey kommand sojas and all of dem get dia work for di kingdom. Dem sey make each group dey serve one mont for evry year and na 24,000 men dey each group.