7 Shemaya sons na: Otni, Refael, Obed, Elzabad. En relashon na Elihu and Semakaya and pipol dey respet dem too.
Obed-Edom first pikin Shemaya still born sons wey bi leaders and pipol dey respet dem well-well.
All dis na Obed-Edom family. Pipol dey respet dem well-well, bikos dem sabi do dia work. Dem bi sixty-two wey rilate to Obed-Edom.
Kore wey Ebiasaf born, na-im pikin Shallum, with Korah pipol dey guide di door-mot for di tent where God present dey, just as dia grand-grand papa do before.