19 Dis na how dem take divide di guards wey bi Korah and Merari family.
So dem go Samaria kon tell di guards wey dey di gate sey: “Wi go Siria sojas kamp and wi nor si anybody for der; dem run leave all dia horse and donkey and di tent bi as dem leave am.”
Na four guards dey di kourt for di west, while two dey inside di kourt.
Oda Levi pipol dey guide di precious tins wey dey di temple and di store room wey dem put di tins wey dem dedikate give God.
Korah pikin na Assir, Elkanah and Abiasaf. Na dis pipol bi Korah family.
So, na God una dey gada against! Who Aaron bi wey una dey komplain about?”