Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 25:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Na dia papa dey lead dem and dem dey sing for God Temple, dey play cymbal and oda instrument as dem dey serve for der. But na di king dey supavise Asaf, Jedutun and Heman.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 25:6
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David and Israel pipol sing and dance well-well to take honor God. Dem dey play harp, jita, drums, sheke-sheke and cymbals.


King Solomon use di wood take build rails for di temple and di palis. E still use am make harp and lyre for doz wey dey play music. Di junipa wood wey fine pass, na-im dem bring kom Israel and e nor get any oda wood like doz ones again.


David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”


Doz wey dey sing na Heman, Asaf, Etan and na dem dey play di bronze cymbals;


Bikos Kenanaya sabi play music well-well, dem kon make am dia leader.


4,000 wey go dey guide and anoda 4,000 wey go dey praiz God with di music instrument wey di king make.


Dem enter Jerusalem with trumpet and oda tins wey dem take dey sing kon dey happy and dance go God Temple.


E si di king stand near di pila for where dem take dey enter di temple. Di ofisas and doz wey dey blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land happy dey blow dia trumpet. Doz wey dey sing, dey der with difren instrument as dem dey lead di song. Atalaya tear en klot kon dey shaut, “Dis na wayo! Dis na wayo!”


From Elizafan shidren-shidren: wi get Shimri and Jeiel. From Asaf shidren-shidren: wi get Zekaraya and Matanaya.


Di king follow di advise wey God give King David thru Profet Gad and Profet Natan. E put Levi pipol for di temple with harp and cymbals.


Wi still get Matanaya wey Mikah born, wey Zabdi, Asaf pikin born and na-im dey lead di tanksgivin and prayer. E still get Bakbukaya wey dey support Matanaya and Abda wey Shammua born, wey Galal born, wey Jedutun born.


Dis na di family leaders for Levi tribe: Hashabaya, Sherebaya, Jeshua, Binnui, Kadmiel and di oda men wey dey stand face dem wen dem dey do di praiz and tanksgivin service and just as David wey dey serve God kommand dem, one group dey praiz with di oda group.


Di tradishon to get kwayamasta wey go lead di pipol for praiz, hymns and tanksgivin don start since David and Asaf time.


Pipol wey dey sing, dey waka for en front; while di odas dey play dia instrument dey follow for back and yong girls dey play dia sheke-sheke.


Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ