Dem don give di priest and Levi pipol, di work wey dem go do for di temple. Doz wey sabi work dey ready to help yu and all di pipol and dia leaders go obey yor kommand.”
Wen di men start di temple foundashon, di priests wear dia garment, stand for dia pozishon kon hold dia trumpet for hand. Levi pipol wey kom from Asaf family still stand der too with dia cymbals. Dem praiz God akordin to wetin dem rite down for King David time.