Just like di leaders for Aaron family, dem divide dia work give dem with dice wey dem trow without sey dem use age or rank. King David, Zadok, Ahimelek, di priests and di leaders for Levi tribe dey der and dem do evritin for dia front.
and Zabud wey bi di leader for God Temple. Na Hilkaya wey Meshullam born bi en papa. Zadok wey bi Meraiot pikin, na-im bi Meshullam papa. Meraiot na Ahitub pikin.
En ofisas still use dia mind give di pipol, di priest and Levi pipol some tins too. Priest Hilkaya, Zekaraya and Jehiel wey bi leaders for di temple, give dem 2,600 lamb and yong goats and 300 melu for di Passova.
So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am.