King Solomon use di wood take build rails for di temple and di palis. E still use am make harp and lyre for doz wey dey play music. Di junipa wood wey fine pass, na-im dem bring kom Israel and e nor get any oda wood like doz ones again.
So dem go Samaria kon tell di guards wey dey di gate sey: “Wi go Siria sojas kamp and wi nor si anybody for der; dem run leave all dia horse and donkey and di tent bi as dem leave am.”
David tell some Levi pipol sey, make dem lead di pipol as dem dey woship for di Kovenant Box front kon dey sing and praiz di Oga wey bi Israel pipol God.
Some family for Levi; dia work na to dey play music for di temple. Doz wey dey head dis family dey stay di rooms for di temple and dat na only wetin dem dey do, bikos dem fit koll dem to play, both for day and nite.
Doz wey dey play music with Asaf shidren-shidren face dia own pot, just as King David tok thru Profet Asaf, Heman and Jedutun. Di guards nor komot from dia pozishon, bikos Levi pipol prepare sometin for dem too.
As en papa David tok, Solomon choose difren priests to do difren tins. E choose Levi pipol wey go dey lead woship and help di priest for dia work evriday and doz wey dey guide di gate. Dis na wetin David, God savant tok.
For di sevent year wey Atazazes dey rule, Ezra komot from Babilon go Jerusalem with some Israel pipol and some among dem na priests, Levi pipol, doz wey dey sing for di temple, temple guards and workers.
Di Priest, Levi pipol, doz wey dey guide di gate, doz wey dey sing, di temple savants and evry oda pesin for Israel kon stay for di town. So for di sevent monts, Israel pipol kon start to stay for dia towns.