King Hiram for Tyre kon send business men go meet David, e send cedar woods with karpenters and doz wey dey do stones go meet David make dem take build di palis.
King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David.
King David tell all di pipol, “Na Solomon my pikin God choose, but e still dey yong and e neva sabi many tins. Di work wey dem won do dey hard, bikos dis nor bi palis for man, but na temple for di Oga awa God.
So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.
Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.