4 But David make Joab obey en kommand. So Joab travel round Israel kon kom back to Jerusalem.
Joab ansa, “God go make Israel pipol many pass di way dem bi naw! But my oga! All di pipol na yor own, wetin make yu won do dis tin kon put di whole kountry for wahala?”
E tell David, “Di men wey fit bi sojas for Israel na 1,100,000 and for Judah, dem bi 470,000.”
But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys.
Anytin wey e kommand, pawa dey follow am and nobody go fit go against or kweshon en authority.
But even if E nor save us, wi wont make yu know sey, wi nor go serve or woship yor gold image.”
But Pita and di apostles ansa, “Wi go must obey God instead of human being.