So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel.
Joab wey en mama na Zeruaya kon bigin kount di pipol, but e nor komplete am. God kon ponish Israel for wetin dem do, so dem nor fit rite di real nomba for King David own book.