7 E dey trobol Israel pipol, but na Jonatan wey David broda, Shimea born, kill-am.
Eliab na Jesse first pikin, why Abinadab na di sekond born, follow by Shimea,
Anoda fight happen for Gat, where e get one giant wey get six fingers for en hand and six toe for en leg. Na di giants family for Gat, e from kom.
All dis men na giant, Rafa shidren-shidren for Gat and na David with en men, kill dem.
Jonatan wey bi David papa broda na betta advise and e know wetin e dey tok. Na en and Hakmoni pikin, Jehiel dey tish di king sons.
“ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since? Yu nor dey respet mi wey bi Israel God wey dey holy.
Den Jesse koll Shammah. But Samuel sey, “God nor choose dis one too.”
Den e kon sey, “I dey shalenge Israel sojas today sey, ‘Make una pick one pesin, make e kon fight mi!’ ”
David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”
Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”