Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 20:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Di next rainin sizin, for di time wen kings dey go fight, Joab karry en sojas go skata Ammon land; but David stay for Jerusalem. Dem attack, distroy and seize Rabbah town.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 20:1
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Before dry sizin, for di time wey kings dey go war, David send Joab with en ofisas join Israel pipol sojas and dem defeat Ammon pipol kon take-ova Rabbah town. But David stay for Jerusalem.


Wen David rish Mahanaim, e si Shobi, Nahash pikin and dem kom from Rabbah town for Ammon. E still si Makir wey bi Ammiel pikin wey kom from Lo-Debar and Barzillai wey kom from Rogelim for Gilead.


Den di profet go meet King Ahab kon sey, “Make yu go back go train yor sojas kon make plan, bikos Siria king go attack una again for di next rainin sizin.”


For di next rainin sizin, e gada en men kon follow dem mash go Afek town go attack Israel pipol.


So Elisha die and dem kon beri am. But as anoda year dey start, Moab pipol kon attack di land.


Wen di kings wey dey respet King Hadadeza si sey Israel pipol don win dem well-well, dem kon go make peace and bigin obey King David. So Aramean pipol nor gri kon help Ammon pipol again.


Na mi kreate di man wey dey melt gold, make fire and form weapon and na mi still kreate di soja wey dey use di weapon kill pipol.


I kon ask, “Oga God, how long dis tins go take happen?” E ansa, “Na till di town skata finish and nor-tin go dey inside again. Till nobody dey stay di house and na until di land don turn where dem dey trow dirty put.


One road go show di king where e go pass rish Ammon town for Rabbah and di oda one go show am Judah road; di strong town wey dey Jerusalem.


I go turn Rabbah to where dem go dey keep kamel put and evriwhere for Ammon go bi where dem dey keep sheep, den una go know sey, na mi bi God.


So, I go skata Rabbah town kon burn all dia strong-strong buildings rish groun. Wen di war start, pipol go dey shaut and e go bi like wen heavy breeze dey blow and strong rain dey fall.


For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ