19 Wen Azuba die, Kaleb kon marry Efrat and e born Hur for am.
Kaleb wey bi Hezron pikin marry Azuba wey dem still dey koll Jeriot. En sons na: Jesher, Shobab and Ardon.
Na Hur bi Uri papa and na Uri born Bezalel.
Afta Hezron don die, Kaleb kon sleep with Efrat wey bi en papa wife and e born Ashhur wey bi Tekoa papa.
All dis na Kaleb shidren-shidren. Hur wey bi Efrat first pikin, na en sons bi dis: Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa;
Na Penuel bi Gedor papa, while Ezer kon bi Hushah papa. Hur wey bi Efrat first pikin and Betlehem pipol papa, na en shidren-shidren bi dis.
So Joshua fight Amalek pipol just as Moses tell am, den Moses, Aaron and Hur kon go top of di hill.
But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.