18 Kaleb wey bi Hezron pikin marry Azuba wey dem still dey koll Jeriot. En sons na: Jesher, Shobab and Ardon.
Abigail born Amasa wey en papa kom from Ishmael tribe.
Wen Azuba die, Kaleb kon marry Efrat and e born Hur for am.
Afta Hezron don die, Kaleb kon sleep with Efrat wey bi en papa wife and e born Ashhur wey bi Tekoa papa.
Kaleb wey bi Jerahmeel broda, en sons na: Mesha wey bi Zif papa and en sekond pikin na Maresha wey bi Hebron papa.
Kaleb girl-friend wey dem dey koll Efah kon born Haran, Moza and Gazez. Na Haran bi Gazez papa.
Di sons wey dem born give Hezron na: Jerahmeel, Ram and Kaleb.
Judah shidren-shidren na: Perez, Hezron, Karmi, Hur and Shobal.