Absalom sey make Amasa take Joab place as di sojas oga. Amasa na Itra pikin wey kom from Ishmael tribe and en mama name na Abigail, Nahash pikin. Zeruaya wey born Joab, na en sista bi Nahash.
David still tell dem make dem tell Amasa, “Una bi my own relashon, from today go, I dey put yu for Joab place make yu rule my sojas. Make God ponish mi if I nor do wetin I tok!”
God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.
“E still remain one tin: yu remember wetin Joab do mi wen e kill two kommander for Israel sojas, Abner wey bi Ner pikin and Amasa wey bi Jeta pikin. E pritend kill dem like sey dem dey fight and dat time peace dey evriwhere, kon stain en belt and sandals with innocent blood.
Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.