14 Wen Joab with en pipol attack, Aramean pipol kon bigin run.
Wen Joab with en sojas attack, Siria sojas kon bigin run.
But one profet go meet Ahab kon tell am, “God sey, ‘Make yu nor fear doz many sojas! I go make yu win dem today and yu go know sey, na mi bi God.’ ”
Make yor heart dey strong! Make wi fight for awa pipol and God town and make God do wetin dey en mind.”
Wen Ammon pipol si Aramean pipol dey run, dem too kon start to run from Abishai go inside dia town. Den Joab and en sojas kon go back to Jerusalem.