Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 19:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Make yor heart dey strong! Make wi fight for awa pipol and God town and make God do wetin dey en mind.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 19:13
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Make yu get heart and dey strong! Make wi fight well for awa pipol and for God towns and make God do wetin dey en mind.”


But if E dey vex for mi, make E do wetin E like with mi.”


Joab tell Abishai, “If yu si sey Aramean pipol dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon pipol dey opress yu, I go kom help yu.


Wen Joab with en pipol attack, Aramean pipol kon bigin run.


So make yu get up, bikos na yor rite to take akshon. Wi dey yor back, so go do as yu fit sey God wont.”


I si sey di pipol dey worry, so I kon tell dem, dia ofisas and dia leaders sey, “Make una nor fear awa enemies. Make una remember how great and mighty God bi, den make una fight for una brodas, shidren, wifes and una house.”


With all dis tins wey dey happen so, Job nor ever blame, sin or curse God.


So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.


Make una shine una eye and dey strong for una faith and stand with boldness.


Make sure sey yu dey strong well-well and yu get heart! Make yu dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give yu! Nor do dem anyhow, den yu go prosper for evritin wey yu dey do.


Den Joshua tell dem, “Make una nor fear or shake. Make una get heart and dey strong, bikos God go do di same tin to all una enemies wey una dey fight against.”


But Israel pipol tell God, “Wi don sin. So do us anytin wey Yu like, but today, wi dey beg sey make Yu kom save us.”


David tell Saul, “Nor let anybody mind fail am. Yor savant go-go fight dis Filistia man!”


So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”


So Filistia pipol, make una dey strong kon bihave like men, if not una go serve Hibru pipol di way wey dem don serve una! Make una fight dem like men!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ