6 Den David set soja kamp for dia aria kon dey rule and kollect tax from dem. God give David viktory for evriwhere.
I dey follow yu go anywhere wey yu dey go kon let yu win all yor enemies. I go make yu dey popula like all di strong men for dis eart.
E still win Moab pipol kon bigin rule and kollect tax from dem.
Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help King Hadadeza, David attack and kill 22,000 sojas.
David karry all di gold shield wey Hadadeza sojas take dey guide diasef for war, go Jerusalem.
God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.
Pesin fit ready en horse sey e dey go fight war, but na only God go gi-am viktory.
David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.