15 Abishai wey bi Joab broda, naim bi di sojas oga and na Jehoshafat wey Ahilud born, dey keep rekord.
Joab wey en mama name na Zeruaya, naim dey kommand di sojas, while Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep rekord.
Elihoref and Ahijah wey bi Shisha shidren na dem bi seketry for di kourt. Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, na en dey keep rekord.
David sey, “Di first man wey go attack Jebus pipol, na-im go bi di sojas oga!” So Joab wey en mama na Zeruaya, first attack and kill dem, so e kon bi di sojas oga.
David rule Israel land kon make sure sey dem dey trit en pipol well.
Ahitub pikin Zadok and Ahimelek wey Abiatar born, na dem bi priests, while Shavsha kon bi seketry for di kourt.
Jehoiada wey Abiatar born give Benaya, na-im kon take-ova from Ahitofel. Na Joab bi di whole sojas oga.