3 Dat nite, God kon tell Profet Natan,
‘From di time wey I bring my pipol kom out from Egypt, I neva choose any town among Israel land where dem go build temple put to woship mi, but I choose yu, David, so dat yu go rule my pipol.’ ”
Natan ansa, “Make yu do wetin dey yor mind, bikos God dey with yu.”
“Go tell David my savant sey, ‘Dis na wetin God dey tok: “Make yu nor build house for mi.
Una go hear one vois dey tok from una back sey, “Na di korrect way bi dis, make una waka pass der,” weda una dey waka go rite or left.
Before God wey get pawa do anytin, E go first show en plans to di profets, wey bi en savant.
God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.