26 My Oga God! Yu bi God and Yu don promise mi all dis wonderful tins.
My Oga God, I dey pray with all my heart, bikos Yu don show and tell yor savant sey, ‘I go make yor shidren-shidren rule forever.’
And naw, Yu don choose to bless my family so dat wi go dey with Yu forever, bikos if Yu my God bless pesin, di blessing go dey forever.”
Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.