No kountry for dis world bi like Israel pipol wey Yu save from doz wey opress dem kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, don make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt kon drive oda pipol komot from di land for dem.
Israel pipol, na una bi my witness. I choose una as my savants, so dat una go know, bilive and undastand sey na mi bi di only God. E nor get any oda god wey dey apart from mi. E neva dey before and e nor go ever dey.
God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.